Connect with us

News

Mali Coup: Soldiers arrest President Ibrahim Boubacar Keïta and im PM

Avatar photo

Published

on

Ibrahim Boubacar Keïta

Soldiers don arrest Mali president on Tuesday some hours afta dem start mutiny for Kati camp.

President Ibrahim Boubacar Keïta, bin dey im house for Sebenikoro, Bamko, wen some soldiers come arrest am around 4:30pm Mali time.

Mali goment tok-tok pesin, Yaya Sangaré, tell BBC say di military arrest am wit di Prime Minister, Boubou Cissé.

Read also

Gunmen abduct Ex-commissioner’s children and NSCDC officer in Zamfara

Germany: Outrage over video of officer placing a knee on man’s neck

Di kontri don dey boil for some months now sake of politics palava as kontri pipo bin do plenty protest for di president to resign sake of di plenty jihadist attacks plus corruption for di economy.

Malian soldiers are celebrated as they arrive at the Independence Square in Bamako, Mali - 18 August 18, 2020.

Wetin we call dis foto,France, Mali former colonial master, want make soldiers return to barracks

Tins dey happun very sharply. Di tin wey bin first start early today as mutiny be like say e don turn coup.

Di coup begin wit gunfire inside di military base wey dem about 15km from di kontri capital Bamako on Tuesday morning.

Young pipo for di capital bin burn goment building.

Dis one happun some hours afta some junior officers detain some senior military officers.

Ecowas and Mali former colonial master France, don condemn di attack.

France foreign minister Jean Yves Le Drian, say im kontri condemn di attack “in di strongest term dis na serious mata.”

Violent jihadists don dey take advantage of di katakata wey dey happun for north of Mali and dem still dey kill and destroy.

Tori be say small crowd bin gada to support di soldiers.